Connect with us

Hi, what are you looking for?

Black Stars

Andre Ayew Penalty help Ghana progress to next round of World Cup qualification

Ghana don progress to di next round of qualification for Qatar 2022 World Cup afta dem beat South Africa 1-0 on Sunday.

Andre Ayew first half penalty prove to be di decisive goal as Ghana finish top of Group G.

Ghana wey never lose wen dem play for di Cape Coast Sports Stadium since 2009 finish top wit 13 points, same points wit South Africa. But dem get better goals scored record.

Ghana join Mali, Egypt, Senegal, Morocco and DR Congo as kontris wey don qualify for di next round as group winners.

Di next round go see di 10 group winners face eachoda but only 5 go progress to next 2022 World Cup.

How di game go

First half update

Both teams just sing dia anthem finish and na South Africa go take di first pass.

2mins – Ghana create wetin look like di first chance as Mohamed Kudus cross to Andre Ayew dey flagged for offside.

7mins – Mohammed Kudus free kick land on top South Africa net, goal kick.

10mins – South Africa threaten to score, but referee blow say Hlongwane bin don foul. Now Mohammed Kudu wey don dey ginger dey down, e be like im don get injury.

13mins – Daniel Koffi-Kyareh don replace Mohammed Kudus.

14mins – Chance! Jodan Ayew hold off im marker come run direct towards goal but Tarence Mashego cover quickly to block di Crystal Palace man shot.

16mins – Koffi-Kyareh dey through on goal but im blast e shot over. Two big chances wey Ghana don miss now.

25mins – Ghana don control much of di ball and dey ask South Africa defence questions so far, but dem don always provide di ansa so far.

32mins – Penalty for Ghana! De Reuck dey guilty of pulling down Amartey inside di penalty box.

33mins – Goal!!! Andre Ayew send di goalkeeper di wrong way. Ghana 1-0 South Africa.

If e finish like dis Ghana go qualify wit better goals-scored record. Dem get seven while South Africa don score 6. Both teams go finish with 13 points.

45mins – Not much don happun so far since di goal. Di referee don add 2mins before half-time.

Half-time – Ghana lead 1-0 and dem also lead di group on goals-scored as e stand.

Second half

Ghana begin di second half wit 1-0 lead.

55mins – Jordan Ayew win freekick for good area. Di forward take di kick himsef but di South Africa goalkeeper comfortably catch am.

63mins – Referee give Siyanda Xulu yellow card for fouling Jordan Ayew wey don dey cause Bafana Bafana defence trouble.

66mins – Sulemana dance im way to di wing before e stand up one cross wey di Ayew brothers no fit decide which of dem go nod am.

69mins – Percy Tau dribble im way past Ghana defenders, but Wollacott comfortably save im shot. Good move.

70mins – Substitution: Keagan Dolly replace Brooks.

78mins – Chance! Sulemana fail to hit di target afta South Africa goalkeeper rush out from im goal. But di Rennes player fail to capitalise.

86mins – Substitution: South Africa make dia second change Thibang Phete OUT, Lakay IN.

87mins – Now na Ghana turn to make substitution, Richmond Boakye replace Kaldeen Sulemana.

90mins – Foul on Wakasso. Im dey in pain as di referee add three extra minutes.

90+3mins Wollacott collect yellow card for time wasting.

Full Time: Ghana qualify for next round of qaulification for Qatar 2022 Wold Cup. Ghana 1-0 South Africa.

Credit: BBC Pidgin

You May Also Like

Boxing

The British Boxing Board of Control (BBBofC) issued a memo today stating that they are “not considering applications for any Ghanaian boxers.” This means...

African Cup Of Nations

The Black Stars’ appearance in the 2021 edition will be their 23rd time and they will be keen to end their long awaited drought...

Combat Sports

Malaysia based multi decorated Ghanaian kickboxer, Gerald Dah is in high spirits ahead of his latest fight this Friday after safely landing in Kuala...

Marathon

With unwavering grit and determination, a 76-year-old athlete has conquered a challenging marathon, earning herself a well-deserved standing ovation from the crowd. This remarkable...